Give dog dem wey dey hala meat See if dem go start to fight, Give drunkard saline See if drink wahala go clear small. No let crow dem fat Pursue chop chop raven dem, But allow lover dem make dem love, Allow dem to stay for fine place wey noise no dey. You must plant seed and Soon dem go comot from ground if you plant dem well. Good, I go dey loyal Only allow me make I dey free! Dem give dog dem small small meat dem But look! Dem no fight. Dem give shakis people vodka, but even Small one dem no drink. Pursue pursue bird dem no scarce But raven dem no care. Dem put lover dem two two But na separate dem want. Dem put seed inside ground, but confusion dey! No seed comot from ground. Dem give me freedom yesterday, Wetin I go do with am now?
© Chidi Anthony Opara. Translation, 2015