When cold dey We fit dey wan waka. Other place dem dey attract us; Waka go Kiev or Brest. When cold dey we fit. Something dey Wey dey make us waka Go new place dem From di small small thing dem wey we dey do for house. May be, more jolly jolly, Something dey. House dem dey warm us and still We no dey fit relax, We dey wan meet new friend dem, May be dem fit heal di pain dem Wey we dey get if we dey alone. Even though di visit dem Dey make us happy, We dey come back, Our head dey scatter. Where our star dey? Here or far far?
© Chidi Anthony Opara. Translation, 2015