No cross dem dey On top of brother dem grave dem, No widow dem dey cry Near di grave dem. Somebody don put flower pot dem, Come put light wey no dey quench. Di ground don rise up for dis place, But now dem don cover am with stone dem. For dis place, Wetin life dey bring no dey one one, dem join together. Inside di fire you see tank wey dey burst, You see small small Russia house dem wey catch fire, Di town of Smolensk and German debate house wey dey burn And soldier heart wey dey burn. No cry cry widow dem Stand near brother dem grave dem, Di people wey come here strong. No cross dem on top brother dem grave dem, But dat one go make di wahala small?
© Chidi Anthony Opara. Translation, 2015